By Akinleye Akinkunmi
As 2027 dey come, one question dey for everybody mouth for Oyo State: “Who go really feel our pain and do the work?” From Bodija market to Saki, from Kishi to Igboora, from oyo alaafin to ogbomoso , from Iseyin to ipapo, from Tede to igboho, the name wey people dey mention more and more na Barrister Akeem Agbaje.
See why o
1. Na Our Own Pikin, E Sabi the Street and the Law
Barr Akeem Agbaje no be stranger. Born and bred Ibadan, son of the Agbaje family wey everybody know. As one trader for Oja’ba Market talk am: “Akeem na lawyer wey sabi say law no suppose punish poor man. If he enter, he go remember us.” His legal background means he won’t run government like some gambler — due process go dey yanfun yanfun
2. E Get Respect for Kabiyesis and Still Sabi Technology
Oyo people love their tradition, but we also want jobs and light. A market woman in Ogbomoso put am like this: “The man dey greet baba and mama well, but him head dey work for computer age too. Na that kain governor we want.” Agbaje dey bridge that gap — he dey prostrate for royal fathers and still dey discuss how to bring tech hubs to Oke-ogun and agri-processing to Iseyin.
3. Work, Food, Money — Na Wetin We Want
Make we talk truth, wahala of Oyo today na job. Graduate dey plenty, work no dey. A youth leader in Okeho said: “If Agbaje become governor, investors go trust Oyo. The man get mouth for Lagos and abroad, e go bring dem come.” From the Ibadan dry port to cashew in Ogbomoso and tourism in Ado-Awaye, his focus na to open Oyo for business so our children no go dey japa again.
4. APC Need Peace, Oyo Need Unity
After the quarrel of 2019 and 2023, APC for Oyo need person wey no get enemy. Party elder for Afijio talk am: “Akeem no dey insult people up and down. He be cool head wey fit carry everybody along.” Non-party people sef like am because he dey talk sense, not just politics.
5. So If Agbaje Enter 2027, Wetin Go Happen?
– No more ‘I no know’ government: Law go dey, and everybody go know where dem stand and he go be people friendly government not like the one wey dey fry akara for Ido on top say he demolished citizens houses and people painn on top am.
– School go make sense: As one teacher for Ibarapa talk: “Make my pikin no dey sit for floor again. Agbaje na father and he grew up in the ghetto of Ayeye, he go understand.”
– LGs go work: Money for local government go reach local government, so road to your village fit see tar in your life time.
– Security wey get sense: Work with Amotekun, police, baales and technology so farmer for Iwere-Ile fit sleep well well.
As one okada rider for Challenge talk am yesterday: “We don see governors wey dey make noise. This time, make we try person wey get brain and still get human feeling. Na Akeem omo won ni Ayeye be that one.”
Oyo don raise great leaders before. For 2027, we need brain + heart + street sense. That na why plenty people for Oyo State go glad to have Barr Akeem Agbaje as governor.
Akeem Adedeji Agbaje tiwantiwa ni o , make we all support good thing because of our pikins dem.

